Monday, September 29, 2014

For we men

One mosquito just breeze pass my ear nana nana.. come tell me say some people neva still see d correct and latest pant in town for we men dem.. ehen . so i come take am as my consignment to show una the correct  pant for we men dem wey dem fit wear to beach and swimming pool......


ehnnn now wey una don see am,babes abeg you go fit allow you bobo wear dis kind thing waka for swimming pool? not to talk of beach sef. talk true o

machine wey go helep you taste you food

Your tongue dey get wahala to dey taste food? abi you just lazy and you no fit taste food wey dey your front abi d food wey you cook, oya ooooo, Ndi chinese have do Robot taster  wey don come to helep una taste food



you fit watch the video of how the machine take dey taste and you also fit read the remaining tory from http://nyti.ms/1rDBBiT just click ontop the link and e go carry you go the machine....

pishure for 2day


my country people... i don bring una the beta underwear wey go helep una to dey do all the important business any wear wey una dey... hehehehee


Friday, September 26, 2014

pichures wey make brain *wink*

And na so some people no jut dey try with common sense wey no to common sha hahahahaha





 u go fit see the remaining pichures wen you continue...

fake Uti on the loooseee!

Na wa oooo, one babe don comot yarn say one pesin wey dey claim say em be Uti Nwachukwu invite her for BBM. she say she know say na scam as e b say Uti gan gan don use em mouth talk say, make people dey very careful o, say plenty plenty fake Uti full ground, and as a wise babe naaa she sef follow the guy do jonny just come *wink*

The guy say em go give the babe N12m modelling contract ( for em mind o, e tink say em go fit congo the babe chai lols) e come dey ask the babe weda she go fit follow any kain pesin sleep make she for fit get the contract sharp sharp. The babe kuku don know say all na wash she sef no gree the guy, d guy see say na rock e jam, e use speed delete the babe b4 she pour sand sand for em garri. hahahaha.....
the smart babe save all the message dem of fake Uti send am to twitter.. corrrreeeccttt....


so for the guy mind now him be scammer for africa rowl... mtchewww.. if to say the babe knw sef, she for save the pin dash am to plenty people mke dem for dey add the guy dey go..nonsense...
na the chat wey the girl send dey under...after the cut

Thursday, September 25, 2014

This tory na true tory o..and i wan make una use una own church mind tell me wetin una think..



ok, so, one man for obodo oyibo London Mr Lefkos Haji carry $10,000 (choiiiiii rolling my eye) engagement ring put inside ballon sake of say em wan propose give em girlfriend.. but gbage come shelle.. as the man carry the ballon dey go, na so one heavy breeze carry the ballon go piaaaaaa.....






na so the man pik race come dey pursue the ballon, good 2hours the man still dey find ballon....the man come finally come back go meet em suposed wife to be.. and the woman say lie lie she no go follow am talk until she se new ring for the man hand..



oya, my quention.1. my babes abeg una see the proposal as romantic? quention 2. if you be the woman wetin you for do?

Monday, September 15, 2014

today pishure

if them pay you 1million Naira say make u carry yourself and your family them go live for this house....


Tuesday, September 9, 2014

wetin you tink?

where you tink say dis stool go fit stay for una house?

hmmmmm....