Welcome to Olivia's Blog
Weird, Funny but True facts all in pigin...
Friday, October 19, 2018
After 2years pikin wey dem bury, waka come house...
Wahala comes to town as girl wey don die since 2years ago waka enta her parents house.
Tory get am say the girl name na Winnie and she bin die after one kin sickness catch am. Dem say dem carry the body go mortuary before dem later bury am for church inside Mitingo cemetery only for her to waka come house come shock her family after 2years.
After plenty questions, the girl come talk say no be she dem bury.. say na banana tree.
Inside police station na em dem carry mata go, the girl parents and dem neighbours follow go make dem see the DNA test result wey dem do for the girl body.
The parents of the girl carry the death certificate and birth certificate of the girl give police make dem for help investigate the mata well.
This tory happen for Masala, one quiet town inside Ndola Zambia.
Source; https://www.nationalhelm.co/2018/06/shock-as-girl-who-was-buried-2-years-ago-walks-back-to-her-parents-house-photos.html
Thursday, October 18, 2018
IF NO BE LOVE, E NO GET ANOTHER NAME
https://youtu.be/ik7b0l83pGU
No be only human beings dey get unwanted pregnancies.. e be like say animal sef dey get am, see as this lion mama born am finish waka say she no want am.
Curled from BBChttps://youtu.be/ik7b0l83pGU
CREATIVITY OR TRASH?
1. You feel say this cake no dey appropriate for the occasion and e lack creativity?
2. If you go baby shower, see this kin thing as cake, you go follow chop?
Wednesday, October 17, 2018
So, I still dey try understand something .. this thing wey oyibo dey call "Halloween" why we "Nigerians" dey celebrate am??? Una fit correct me if i dey wrong o, but oyibo dey follow us celebrate sango or ogun festival?
See ehen, follow follow dey land pesin inside kòto o...
Wednesday, February 18, 2015
HUMAN BEING HEAD AS WEDDING CAKE!!!!????
See as this couple fineeee...dem come do wedding wey reach $200,000 only to open cake and na dir head dem present as cake for them guest.
wetin you think sey be dir intention? dem no bin want make people follow them celebrate? because for dir mind d cake dey very symbolic and to dem, e mean till death do us part as na wetin dem kuku ma write ontop the cake.. see the cake after the cut
Monday, February 9, 2015
2baba sey our pikin dem suppose dey learn pigin for school
infact ehenn 2baba, i agree with you oooo butttt.... you know sey our children brain dey catch fast, make dem no come catch am pass english or dem native dialect.. make una take una ear hear 2baba as e talk am ontop Mtv Base
Saturday, February 7, 2015
Subscribe to:
Comments (Atom)


