Friday, October 19, 2018

After 2years pikin wey dem bury, waka come house...


Wahala comes to town as girl wey don die since 2years ago waka enta her parents house.

Tory get am say the girl name na Winnie and she bin die after one kin sickness catch am. Dem say dem carry the body go mortuary before dem later bury am for church inside Mitingo cemetery only for her to waka come house come shock her family after 2years.

After plenty questions, the girl come talk say no be she dem bury.. say na banana tree. 

Inside police station na em dem carry mata go, the girl parents and dem neighbours follow go make dem see the DNA test result wey dem do for the girl body.

The parents of the girl carry the death certificate and birth certificate of the girl give police make dem for help investigate the mata  well.

This tory happen for Masala,  one quiet town inside Ndola Zambia. 



Source; https://www.nationalhelm.co/2018/06/shock-as-girl-who-was-buried-2-years-ago-walks-back-to-her-parents-house-photos.html

No comments:

Post a Comment