Friday, September 26, 2014

fake Uti on the loooseee!

Na wa oooo, one babe don comot yarn say one pesin wey dey claim say em be Uti Nwachukwu invite her for BBM. she say she know say na scam as e b say Uti gan gan don use em mouth talk say, make people dey very careful o, say plenty plenty fake Uti full ground, and as a wise babe naaa she sef follow the guy do jonny just come *wink*

The guy say em go give the babe N12m modelling contract ( for em mind o, e tink say em go fit congo the babe chai lols) e come dey ask the babe weda she go fit follow any kain pesin sleep make she for fit get the contract sharp sharp. The babe kuku don know say all na wash she sef no gree the guy, d guy see say na rock e jam, e use speed delete the babe b4 she pour sand sand for em garri. hahahaha.....
the smart babe save all the message dem of fake Uti send am to twitter.. corrrreeeccttt....


so for the guy mind now him be scammer for africa rowl... mtchewww.. if to say the babe knw sef, she for save the pin dash am to plenty people mke dem for dey add the guy dey go..nonsense...
na the chat wey the girl send dey under...after the cut














1 comment:

  1. Scammers on the loose. We really have to be careful about who we accept and share our personal details with

    ReplyDelete