Tuesday, September 30, 2014
Monday, September 29, 2014
For we men
One mosquito just breeze pass my ear nana nana.. come tell me say some people neva still see d correct and latest pant in town for we men dem.. ehen . so i come take am as my consignment to show una the correct pant for we men dem wey dem fit wear to beach and swimming pool......
ehnnn now wey una don see am,babes abeg you go fit allow you bobo wear dis kind thing waka for swimming pool? not to talk of beach sef. talk true o
machine wey go helep you taste you food
Your tongue dey get wahala to dey taste food? abi you just lazy and you no fit taste food wey dey your front abi d food wey you cook, oya ooooo, Ndi chinese have do Robot taster wey don come to helep una taste food
you fit watch the video of how the machine take dey taste and you also fit read the remaining tory from http://nyti.ms/1rDBBiT just click ontop the link and e go carry you go the machine....
you fit watch the video of how the machine take dey taste and you also fit read the remaining tory from http://nyti.ms/1rDBBiT just click ontop the link and e go carry you go the machine....
pishure for 2day
my country people... i don bring una the beta underwear wey go helep una to dey do all the important business any wear wey una dey... hehehehee
Friday, September 26, 2014
pichures wey make brain *wink*
And na so some people no jut dey try with common sense wey no to common sha hahahahaha
fake Uti on the loooseee!
Na wa oooo, one babe don
comot yarn say one pesin wey dey claim say em be Uti Nwachukwu invite her for
BBM. she say she know say na scam as e b say Uti gan gan don use em mouth talk
say, make people dey very careful o, say plenty plenty fake Uti full ground,
and as a wise babe naaa she sef follow the guy do jonny just come *wink*
The guy say em go give
the babe N12m modelling contract ( for em mind o, e tink say em go fit congo
the babe chai lols) e come dey ask the babe weda she go fit follow any kain
pesin sleep make she for fit get the contract sharp sharp. The babe kuku don
know say all na wash she sef no gree the guy, d guy see say na rock e jam, e
use speed delete the babe b4 she pour sand sand for em garri. hahahaha.....
the smart babe save all
the message dem of fake Uti send am to twitter.. corrrreeeccttt....
so for the guy mind now
him be scammer for africa rowl... mtchewww.. if to say the babe knw sef, she
for save the pin dash am to plenty people mke dem for dey add the guy dey
go..nonsense...
na the chat wey the girl
send dey under...after the cut
Thursday, September 25, 2014
This tory na true tory
o..and i wan make una use una own church mind tell me wetin una think..
ok, so, one man for obodo
oyibo London Mr Lefkos Haji carry $10,000 (choiiiiii rolling my eye) engagement
ring put inside ballon sake of say em wan propose give em girlfriend.. but
gbage come shelle.. as the man carry the ballon dey go, na so one heavy breeze
carry the ballon go piaaaaaa.....
na so the man pik race come dey pursue the
ballon, good 2hours the man still dey find ballon....the man come finally come
back go meet em suposed wife to be.. and the woman say lie lie she no go follow
am talk until she se new ring for the man hand..
oya, my quention.1. my babes
abeg una see the proposal as romantic? quention 2. if you be the woman wetin
you for do?
Monday, September 15, 2014
today pishure
if them pay you 1million Naira say make u carry yourself and your family them go live for this house....
Tuesday, September 9, 2014
Friday, August 22, 2014
Oyaaa ooooo, 27 women for brazil don ready for dir yearly “Miss Bum Bum” competition.
Oyaaa ooooo, 27 women for brazil don ready for dir
yearly “Miss Bum Bum” competition.
27 women don dey ground gidigba for brazils finest asset “Miss Bum Bum” competition. all of dem pose give dir bum bum to camera make una for choose who e bum bum reach to win Miss bum bum Brazil 2014. This competition get 2 different waka pass.
Stage 1: dem go first do internet voting and pesin from all the plenty state dem
wey dey the country go dey to look am. And na the voting wey go carry 15 final
girls enta out of the 27….
Stage2: Na here the judges dem go come choose winner inside one
jubilation wey dem go do for November.
na $22,000
(£13,000) be the ogbonge prize wey the winner go carry go house and the winner
go come be the original example of brazil female bottom….
Thursday, August 7, 2014
OYA HEAR THIS ONE............ (na so i hear am o)
·
If you wan helep woman kulele her body, oyanu,
bigin to dey call her “Baby”… because dem don talk sey when dem call woman “baby”, e dey do beta wonderment for her brain wey go
make all the plenty thinking kulele for her body sharp sharp….
·
Before 7 minutes waka pass, any pesin wey dey
normal go don sleep once sleep catch am
·
Snail fit sleep reach 3years make e no chop
·
If you talk “colorful” and you make sure sey ur voice
no comot as you dey talk, na “I love you” d pesin go tink say you
tell am….you tink say na lie? Oya try am
na….
·
E reach 80% of people
wey go don quarrel finish before dem go remember sey chai!! If to sey I talk dis
tin like dis, e for pain am gaannn!
Subscribe to:
Comments (Atom)









