Friday, August 22, 2014

Oyaaa ooooo, 27 women for brazil don ready for dir yearly “Miss Bum Bum” competition.



Oyaaa ooooo, 27 women for brazil don ready for dir yearly “Miss Bum Bum” competition.

27 women don dey ground gidigba for brazils finest asset “Miss Bum Bum” competition. all of dem pose give dir bum bum to camera make una for choose who e bum bum reach to win Miss bum bum Brazil 2014. This competition get 2 different waka pass.

Stage 1: dem go first do internet voting and pesin from all the plenty state dem wey dey the country go dey to look am. And na the voting wey go carry 15 final girls enta out of the 27….
Stage2: Na here the judges dem go come choose winner inside one jubilation wey dem go do for November.
na $22,000 (£13,000) be the ogbonge prize wey the winner go carry go house and the winner go come be the original example of brazil female bottom….
 
 
Hmmmmmm ndi brazil have do dir own ooo..oya Miss wetin we wan do for here???
“Me go suggest Miss Nose Naija” wetin you suggest?

1 comment:

  1. Really?? What's the point, when more than half of the contestants are walking surgical enhancements.
    I think, the the award should be geared towards the doctors that perform these crazy operations.
    Just sad! Self infatuation at its worst and it reeks!

    ReplyDelete