•If u don shout reach 8years, 7 months and 6days, you suppose don produce the kind heat wey go make coffee….. hahaha you go fit calculate how many time you don shout?
•Pesin no fit taste correct food if spit no dey e tongue…. Oya I go explain this one.. dem talk sey if spit no dey your tongue and e dry kakaraka, dem com carry salt put on top am, sey you no go taste am but if chikinny water tiuch am and spit come dey your tongue ehennnn na den u land.. you go come know sey salt dey your mouth…
But no b only salt dem talk sha ooo, any kind food sef follow body..
you fit try am o… e no go bad :D
•You know sey Dog get four toes for back and five for front??? Oya fast fast go check am
•You don eva wonderment why the sea dey like to dey taste salt salt? Oya o, dis one na one of the supposed reasons.. dem talk sey The Blue Whale wey the water, dey release reach 40 gallons of Sperm as e dey touch light. and na only 10% dey enta d woman….. hmm (no be me talk am ooo na wetin me sef see)
• If you carry 10 people put for room, you go see say 7 of them fit believe sey anoda lifedey after dem mud
No comments:
Post a Comment