Wednesday, February 18, 2015

HUMAN BEING HEAD AS WEDDING CAKE!!!!????



See as this couple fineeee...dem come do wedding wey reach $200,000 only to open cake and na dir head dem present as cake for them guest. 


 wetin you think sey be dir intention? dem no bin want make people follow them celebrate? because for dir mind d cake dey very symbolic and to dem, e mean till death do us part as na wetin dem kuku ma write ontop the cake.. see the cake after the cut

Monday, February 9, 2015

2baba sey our pikin dem suppose dey learn pigin for school


infact ehenn 2baba, i agree with you oooo butttt.... you know sey our children brain dey catch fast, make dem no come catch am pass english or dem native dialect.. make una take una ear hear 2baba as e talk am ontop Mtv Base 

Wednesday, February 4, 2015

AH! DEM DONE FIND GOLIATH SKULL OOO!

 i just dey pass my own jeje wen i see this tory sey dem done find Goliath skull...say n afo rthe foot of mount Elah dem dig am comot.. and na one german somborry Dr Martin na em find am


the stone from david sling na em still dey dere so

see am dem dey dig am comot.. you believe this tory so?

NDI FANS OF PDP STOP NAAA!!!!

  NDI FANS OF PDP STOP NAAA!!!!


 when i see this picture, the only thing wey come my mind na sey , so after i read this thing finish i go come wan vote for this man wey dem sey make i vote for abi?.. SMH!!!
Yes! you be fan but haba know the kind tins wey you go dey use and talk for advert campaign..
 if you see this kin advert now, you go vote that party/ pesin?

Tuesday, February 3, 2015

TODAY FOR HISTORY

TODAY FOR HISTORY


·         SOME BLACK AMERICANS WEY FREE COME SETTLE FOR LIBERIA, WEST AFRICA COME TURN THE FIRST GROUP OF COLONISATION PEOPLE FOR LIBERIA FOR FEBRUARY 4 1822.


·         FEBRUARY 4 1976, NA EM ABUJA REPLACE LAGOS AS NIGERIA FEDERAL CAPITAL ONTOP THE FEDERAL CAPITAL TERRITORY ACT OF 1976.

Thursday, January 29, 2015

African



Lion wey dey roar dey make noise, no dey chop
translation
Boasting without action yields no fruit.....

until lion get pesin wey go helep am talk em tory, na hunter tory go still sweat pass. 
translation     
You can never get a full grasp of an event unless you hear both sides of the story

Wednesday, January 28, 2015

TODAY FOR HISTORY


TODAY FOR HISTORY


·         28TH JANUARY 2011, 13 PEOPLE KPAI FOR BORNO STATE AS MEN WEY CARRY GUN SIDON ONTOP OKADA DEY SHOOT.. COME KILL ANPP GOVERNORSHIP CANDIDATE MODU FANNAMI GUBIO


·         NA THIS VERY DAY  JANUARY 28 1985, MICHEAL JACKSON RECORD EM SONG "WE ARE THE WORLD" FOR HOLLYWOOD CALIFORNIA. 

Tuesday, January 27, 2015

2baba don para

Ok ooo so e be like sey 2baba don para oooo...who vex my G my guy this kine early morning ehenn.



Any wey em post this pichure for em instagram page come write caption wey be like sey em dey talk  as people no sabi mind dem business..hmm well i was minding my own oo but i just sey make i help am spread the word...below na the caption. 


una feel sey em dey refer to pesin?

Monday, January 26, 2015

TODAY FOR HISTORY


TODAY FOR HISTORY

 ·         NIGERIA PLAY DEM 5TH RECORDED FRIENDLY MATCH AGAINST LIBERIA INSIDE LAGOS NIGERIA FOR  JANUARY 26TH 1980 AND DEM WIN THE MATCH 1:0



 ·         FOR JANUARY 26 2011, SERIOUS GBEGE HAPPEN FOR BAUCHI STATE NIGERIA WEY DISTROY CHURCH AND MOSQUE, COME KPAI REACH 4 PEOPLE, SAKE OF SAY SOME PEOPLE GET MISUNDERSTANDING ONTOP BOARDGAME.




·         THE NATIONAL RESISTANCE ARMY, (NRA) FOR UGANDA FOR JANUARY 26TH 1986 COMOT DEM CHAIRMAN OF THE MILITARY COUNCIL, PRESIDENT TITO LUTWA OKELLO, COME PUT YOWERI KAGUTA MUSEVENI AS THE NEW PRESIDENT.