Friday, August 22, 2014

Oyaaa ooooo, 27 women for brazil don ready for dir yearly “Miss Bum Bum” competition.



Oyaaa ooooo, 27 women for brazil don ready for dir yearly “Miss Bum Bum” competition.

27 women don dey ground gidigba for brazils finest asset “Miss Bum Bum” competition. all of dem pose give dir bum bum to camera make una for choose who e bum bum reach to win Miss bum bum Brazil 2014. This competition get 2 different waka pass.

Stage 1: dem go first do internet voting and pesin from all the plenty state dem wey dey the country go dey to look am. And na the voting wey go carry 15 final girls enta out of the 27….
Stage2: Na here the judges dem go come choose winner inside one jubilation wey dem go do for November.
na $22,000 (£13,000) be the ogbonge prize wey the winner go carry go house and the winner go come be the original example of brazil female bottom….
 
 
Hmmmmmm ndi brazil have do dir own ooo..oya Miss wetin we wan do for here???
“Me go suggest Miss Nose Naija” wetin you suggest?

Thursday, August 7, 2014

OYA HEAR THIS ONE............ (na so i hear am o)



·         If you wan helep woman kulele her body, oyanu, bigin to dey call her “Baby”… because dem don talk sey when dem call woman “baby”,  e dey do beta wonderment for her brain wey go make all the plenty thinking kulele for her body sharp sharp….

·         Before 7 minutes waka pass, any pesin wey dey normal go don sleep once sleep catch am

·         Snail fit sleep reach 3years make e no chop

·         If you talk “colorful” and you make sure sey ur voice no comot as you dey talk, na “I love you” d pesin go tink say you tell am….you tink say na lie? Oya  try am na….

·         E reach 80%  of  people wey go don quarrel finish before dem go remember sey chai!! If to sey I talk dis tin like dis, e for pain am gaannn!

Kim kardashian and kanye west get this house for mind



Kim kardashian and kanye west get this house for mind




We celebrity couple dem for obodo oyinbo Kim Kardashian and Kanye West,  done get this house for mind sey dem go buy am. The house dey  near kim mama area for younder and e reach 20 million dollars….


The house make brain… hmmmm